He Needs Your Advice:- Should I Follow The Gateman Inside?
I get one new babe her
name na Lovett, this girl fine
die and on top her beauty
na she Olamide sing for
because she carry front and
she carry back, anytime
when I dey with her my
body go just dey do me
t*t*rey. Few days ago she
say make I come her house
come see her,she say if I
reach make I talk to the
gateman, if possible make I
give am small money so that
him go smuggle me enter
inside her room, because the
papa na retired army and
him dey harsh well well for
her matter.
As I reach the house I come
see the gateman for outside
na him I go meet am, na old
man him even be, he wear
short nika and singlet when
don tear and him hold news
paper.
Me:- bros well done o, I
know say na you be
gateman here, abeg lovett
tell me say make I come see
her, hope say she dey?
Gateman:- yes, she is inside
Me:- what of the useless
papa?hope say e no dey
Gateman:- yes
Me:- abeg you go carry me
go lovett room
Gateman:- Okay, let's go in
Me:- okay, but make I first
buy condom for this shop
when dey outside, because
today na me and that her
big yansh go die together o
Gateman:- okay, make it
snappy, I'll be waiting
Me:- wetin tear your singlet
like this nau?
Gateman:- it got torn while
we were doing a little
sanitation
Me:- no worry I go buy
another one for you ehn
Gateman:- thanks a lot
Me:- you be correct guy, and
if you behave well when I
come I go give you small
thing join am
Gateman:- okay, thank you
As I dey find shop when I
go buy condom na him I see
one guy there when come
carry dozen of singlet, I
come ask am say where I fit
buy condom for the area,
him come show me, I come
ask am weather e dey sell
singlet say I wan buy for
somebody, na him e tell me
say as them dey do
sanitation for house na him
oga singlet tear so oga say
make he go buy dozen
come, say na him be
gateman for them lovett
house.
Abeg I no know weather
make I go the house again?
Advice me
Drop your comment.
name na Lovett, this girl fine
die and on top her beauty
na she Olamide sing for
because she carry front and
she carry back, anytime
when I dey with her my
body go just dey do me
t*t*rey. Few days ago she
say make I come her house
come see her,she say if I
reach make I talk to the
gateman, if possible make I
give am small money so that
him go smuggle me enter
inside her room, because the
papa na retired army and
him dey harsh well well for
her matter.
As I reach the house I come
see the gateman for outside
na him I go meet am, na old
man him even be, he wear
short nika and singlet when
don tear and him hold news
paper.
Me:- bros well done o, I
know say na you be
gateman here, abeg lovett
tell me say make I come see
her, hope say she dey?
Gateman:- yes, she is inside
Me:- what of the useless
papa?hope say e no dey
Gateman:- yes
Me:- abeg you go carry me
go lovett room
Gateman:- Okay, let's go in
Me:- okay, but make I first
buy condom for this shop
when dey outside, because
today na me and that her
big yansh go die together o
Gateman:- okay, make it
snappy, I'll be waiting
Me:- wetin tear your singlet
like this nau?
Gateman:- it got torn while
we were doing a little
sanitation
Me:- no worry I go buy
another one for you ehn
Gateman:- thanks a lot
Me:- you be correct guy, and
if you behave well when I
come I go give you small
thing join am
Gateman:- okay, thank you
As I dey find shop when I
go buy condom na him I see
one guy there when come
carry dozen of singlet, I
come ask am say where I fit
buy condom for the area,
him come show me, I come
ask am weather e dey sell
singlet say I wan buy for
somebody, na him e tell me
say as them dey do
sanitation for house na him
oga singlet tear so oga say
make he go buy dozen
come, say na him be
gateman for them lovett
house.
Abeg I no know weather
make I go the house again?
Advice me
Drop your comment.
Comments
Post a Comment